Skip to main content

TUESDAY CORNER (127): Bizuum Yadok

My brother this country hard pass Olumo rock. To survive wan come hard pass to die. 

Why you still dey for di country na? Why you no kuku japa your thing? 

Tah! you think say e dey easy like that? Ask Immigration pipo weda you fit get passport. dem go tell you say rapture don carry dem but if you get #250K passport go comot. People wey dey work for embassy sef don waka sake of di insecurity. To say you hold your passport and visa for hand sef to get dollar na double wahala. Wetin remain now na to roast for here till dem finish election for 2023. Na dat time we go know weda na real hell or semi-hell we don dey inside already.  

Sense dey inside your yarn. But you no think say di CBN redesign of naira fit make money comot from where e dey hide? Plus, I hear say America wan recall all dem old-old dollar before early next year. Maybe Government fit use that opportunity to nap all the pipo wey dey tif-tif our money. 

Make I hear word! Na today? you know hear say dem lok di EFCC boss, Abdulrasheed Bawa, for disobeying court order? Sake of say him no gree release money wey dem steal, gbam! Dem kuku arrest di pikin. 

Baba wey don tey dey violate court order nko? Who go lock am? Where Nnamdi Kanu dey? Wetin dem no do El-Zakzaky?

Who wan lock am? Everybody na potential 'lockee' na. You no fit lock the 'locker'. I even hear say some Arewa youths sef like am as dem embarrass di Bawa guy because e no sweet dem as dem hear say Governor Bello Matawalle of Zamfara State na di next EFCC target. 

E come be like say anyboy wey wan fight corruption for EFCC no dey end well. See as dem dabaru Ribadu. Magu put him hand for mago-mago, now Bawa don dey sawa. Na only Farida waka comot her thing. 

But na dat woman grap di concept na - tif and let tif! 

Hahahahaha! You are a wicked man, my brother. 

You think say I wicked pass Reno O'mockery? Person wey talk say Obi no go come second or third for di next Presidential election, say na 4th him go take. 

Sometimes I dey wonder di kin kain-kain wey dat man with him white goat bia-bia dey take wey dey make am reason like Akpos. Shey na the same Atiku wey Nigerians no gree see for diaspora so tey as them waka enter US na so dem waka comot. Him campaign strategy now na strictly insult. To sell him Oga now hard pass to sell foreign rice for village. 

No mind am. Him no know say Obi go fit win di election. 

No too shout am like that o! You no hear about the punches wey Soludo dey give Obi these day? You know say na madam testimony dey always strong pass side-chick own ba? Things wey Soludo talk sef, I no fit talk am but the summary be say him talk say Obi no go win. 

(put hand for head) Chai! if Obi no go win then we don enter one chance be dat na. 

My guy, cool down. We don dey inside one chance since 1960. Wetin wori me be say the the Soludo sef no gree talk about di Presidential candidate for him party, APGA, wey him talk say na di 3rd largest party be dat. But I bin see the national Chairman of APGA for TV dey talk say dem candidate, Prof Umeadi, go win di next Presidential election. As him see how their supporters surprise, him come talk say, "I know what you are thinking. But with God all things are possible". Bro, na dat one off me. People wey dey talk of structure wan come dey "on God". 

E wan come be like say road don clear for Tinubu be that na. 

Him health nko? 

Nothing wey oyinbo no fit do. See as Baba strong kakaraka na. 

Thunder ⚡ fire you! Na so we go dey dey? 

The only problem now na the drug matter and shrouded history wey journalist dey talk since. But e bin get some Nigerian Presidents before wey dem no know where dem from come the only thing be say dem dey answer name of some states. Make I call names?

Shhh! Off ya mic. last last e be like every candidate get him own skeleton for inside room. Meanwhile, I hear say Tinubu don land for Jos in preparation for him flagoff today. 

Yes o! And I hear say dem don pump money for the event but money still dey scarce. E be like say hijackers don dey practice their profession again o. In any case, make everything finish in peace. E no go make sense if ordinary person kill himself because of people wey go still chop for the same table tomorrow.  

See as you dey mention "chop" like say food dey easy to find for this country. Make I go look for food chop jare. Na pipo wey don get food wey go reach their next life dey find votes now. 

Some of dem dey find fuel for business now. You know say na another thing wey dey add their money be that. 

And if dem catch dem nko? 

Na to destroy the evidence na. Since wey dem dey talk about massive oil bunkering, you don hear any name? Na because di names dey inside fire that

Make I go house abeg. Everything don tire me.

Okay see you next week my brother! 

#FreeLeahSharibu 
#SecureNigeria

Comments

Most Read

Drama in Kwalla as Motorcycle is stolen in Police Station. See details 👉👉

A motorcycle was snapped up by an unknown  person(s) in the office of the Nigeria Police Force, Kwalla . The motorcycle, a Jincheng model belonging to one Naanman of Tugunwan Street in Kwalla town of Quaan-Pan LGA was stolen sometimes in November 2021 when the owner went to the police station to report an incident. The Nigeria Police Force Outpost in Kwalla in conjunction with the Quaan-Pan Divisional Headquarters Baap instantly mount strategies to recover the stolen bike and reports have just reached us that the motorbike have been caught today, 5/1/2022 around 12:05pm. The culprit have just been arrested along with the bike and detained in Kwalla police station with his identity yet to be revealed for the sake of security investigation as he denied not stealing the bike but claimed he purchased it from a third party is said to hail from Kwa town of the same LGA. More details.......

2023: Catholics Berate Lalong Over Attempt To Drag Pope Into Politics

August 11, 2022  Concerned Catholics in Nigeria have called for the suspension of Plateau State Governor Simon Bako Lalong for dragging the name of Pope into local politics that has nothing to do with the Church. According to the group, Lalong should be punished for bringing the name of Pope and the Catholic Church to disrepute while giving his reasons for accepting to serve as Director General of the APC Presidential Campaign Council. Speaking as a press conference in Abuja addressed by National Convener/President, Dr Ben Amodu, said the concerned Catholics in Nigeria are alarmed that Lalong would elect to throw caution into the wind by dragging the revered Catholic Church into local politics in Nigeria for whatever it is worth. “The reference to the Pope in his statement for accepting to serve as the Director General of the APC Presidential Campaign Council was made in poor taste and a puerile attempt to drag the Catholic Church into a matter that has no bearing with the